Wetin Arabambi Don Yan As Soyinka Talk Say Peter Obi Lose 2023 Presidential Election

0
3


Wetin Arabambi Don Yan As Soyinka Talk Say Peter Obi Lose 2023 Presidential Election

Di faction wey Lamidi Apapa dey lead for Labour Party (LP) don yarn on Saturday say di party true true lose di Presidential election wey happun for February 25.

Dem talk say di party Presidential candidate, Mr. Peter Obi and Mr. Julius Abure sabi di true matter of how di party perform for di election.

Dem yan dis for one statement wey Abayomi Arabambi, di spokesperson of di Apapa-led faction of di party talk for Abeokuta, Ogun State capital.

Dem dey support Prof. Wole Soyinka wey tok for South Africa about Nigeria 2023 Presidential election.

Read Also Why Atiku, Obi No Win Presidential Election – Soyinka

According to Arabambi, “E bad and e dey vex person well-well as dem no come siddon well to look how tins fall apart and plan beta beta for di 2027 election. Some people wey no sabi anything con dey yan like say dem be members of Labour Party dey attack our ogbonge scholar wey everybody dey respect sake of say e talk di truth wey dey clear to beta Nigerians.

E talk say, “Di way our factional Chairman, Julius Abure come attack for media sef, be like say pikin dey talk anyhow to e grandfather.”

Arabambi come talk say, “Even Prof. Charles Soludo, wey be governor for Anambra State wey Obi come from, e sef don yan for di past say di possibility wey Obi go carry third position for di presidential race dey very small, make we no even yan of winning.

“As we be party, we know say Professor Wole Soyinka dey talk true based on how dem play di matter. How person go fit talk say e win election based on ogbonge lie, assumption, nonsense talk and no single evidence to support di matter wey e talk. Na only hope say dem go disqualify di person wey dem know say e be real winner make person wey carry third position con dey declared winner without any proof say e get di highest vote na pure court madness wey Peter Obi, Julius Abure and their blind supporters dey do.

“We sabi say we lose that election, na true wey Obi and Abure bin want make e be. Na for beginning dem take do am, even when dem set Presidential campaign council, for North side, Peter Obi use Igbo people as State Coordinators, northerner con dey deputy.

“Now we don see where e carry us go. Person wey no get result sheet for any polling unit, wey no get agents for plenty polling units, e come dey yan say e win election. How e be say we go fit talk say we win?

“Labour Party don come down be regional party under am as e dey only follow people wey dey Igbo region wey dey di national office.”

E still add say, di party dey chop L for plans toward di 2023 election as e be say dem no get logistics wey beta for ground.



Source link

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here