Peter Obi press conference: Labour Party 2023 presidential candidate react to Supreme Court judgement, speak on next step

0
4
Peter Obi press conference: Labour Party 2023 presidential candidate react to Supreme Court judgement, speak on next step


Peter Obi

Wia dis foto come from, Getty Images

Di Labour party presidential candidate for di 2023 elections, say di labour movement and im obedient supporters don become di opposition for Nigeria politics.

Peter Obi say im mission na to promote new Nigeria and dis no go change as im mission no end wit di Supreme Court decision on 26 October.

Obi tok dis one for di press conference wey im give on Monday, for di Nigeria capital Abuja, to tok about how im feel about di Supreme Court ruling of di 2023 presidential elections and how tins dey occur now for di kontri.

Di politician say di way wey tins be for Nigeria na im make “we for Labour movement and Obidients now be di opposition becos di current political situation for di kontri need very strong opposition.

Di tins wey Oga Obi put for front as di mata wey im feel say no be am for di kontri na di Supreme Court judgement on presidential election.

E say di Court decision ignore overwhelming evidence, like Inec disregard im own rules, allegations wey according to am, di court no suppose treat anyhow.

As tins be, according to Obi, Supreme Court abandon im responsibility. “Inec and Supreme court shift di goal post for di middle of di game,” im tok.

But im give im supporters assurance say dis court decision “no be di end of our journey but in fact di beginning. Nigerians hear you, di world take note and we no go forget easily. We go endure, persist until we reach our destination because new Nigeria na our destination. Destination no be event.”

Obi also tok about di issue of office of di first lady wey di Tinubu goment bin establish plus pump money put.

E say wit di condition of di kontri now, di creation and funding of dis office no suppose be and dat money for dey useful to improve di health system for di kontri.



Source link

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here