Netflix: The Night Agent, Queen Charlotte top most watched shows for di first half of 2023

0
2


Collage of Netflix most watched films

Wia dis foto come from, Netflix

Wetin we call dis foto,

Netflix don release report wey show data for 00 billion hours of streaming

Netflix don release viewer data on 99% of dia catalogue for di first time.

Users around di world watch The Night Agent for 812m hours, wey make di political thriller di most viewed show for di first half of dis year.

Pipo don condemn di streaming giant say dem no dey transparent about how content dey perform on dia platform.

Di criticism dey central to dis year Hollywood strikes, wey paralyse di film and television industry for several months.

Actors and writers dey demand for higher royalties for shows wey perform well on streaming platforms.

For one conference call wit di media, co-chief executive Ted Sarandos confam say di lack of transparency about di popularity of dia shows don lead to distrust for di creator community.

E add say Netflix bin keep dia viewer data private as dem dey build di business so dem go fit experiment without giving away crucial information to potential competitors.

“Dis na big step forward for Netflix and our industry,” di company tok for one blog post.

Table show Netflix What We Watched report results
Wetin we call dis foto,

Viewing figures for di first six months of 2023

Netflix image

Wia dis foto come from, Reuters

“We believe di viewing information for dis report… go give creators and our industry deeper insights into our audiences, and wetin dem dey vibe wit.”

Hollywood creative community dey rely on viewing figures from audience data firm Nielsen – wey dem dey release annually – for traditional broadcast and cable television.

Di What We Watched report rank 18,000 titles by di amount of hours viewed between January and June dis year. Di company say dem go dey release di report every six months now.

Covering nearly 100 billion hours of viewing time, oda shows wey feature well well on di list include Ginny and Georgia, Gilmore Girls, Seinfeld, Friends and The Office.

The Mother wey feature Jennifer Lopez wey be di top movie, dey watched for more dan 249 million hours.

Non-English content generate about one third of all viewing and Netflix say di data also show say demand still dey for older titles.

“Success on Netflix dey come in all shapes and sizes, and e no dey determined by hours viewed alone. We get plenty successful movies and TV shows wit both lower and higher hours viewed. Na all about weda a movie or TV show thrill dia audience — and di size of dat audience relative to di economics of di title,” di company tok.

Wit almost 250 million subscribers globally, Netflix na di largest streaming service for di world.

One foto from Netflix show The Night Agent

Wia dis foto come from, Netflix

Since 2021, e dey release steady weekly Top 10 and Most Popular lists, wey show di most-watched movies and TV shows for English and oda languages.

Netflix tok say more dan half of di titles dem release dis year appear on di weekly Top 10 lists.

Di What We Watched report show say 55% of Netflix viewing come from original films and series and 45% from licensed titles, according to Mr Sarandos.

Last year, Netflix launch one separate service wit adverts, wey need more transparency because advertisers want information about di popularity of content.



Source link

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here