Mr Ibu dead: Nollywood actor John Okafor die afta battle with illness

0
11


Mr Ibu die on Saturday afta ilness

Wia dis foto come from, Instagram/MrRealIbu

Wetin we call dis foto,

Mr Ibu na ogbonge comic actor

Plenti ogbonge pipo for Nigeria and within di entertainment industry don dey pay condolences to di popular Nollywood actor John Okafor wey pipo sabi as Mr Ibu wey die on Saturday.

Plenti ogbonge pipo for Nigeria and within di entertainment industry don dey pay condolences to di popular Nollywood actor John Okafor wey pipo sabi as Mr Ibu wey die on Saturday.

Some celebrities bin take to dia social media to pay respect to di late actor.

Mercy Johnson wey dey popular for her movies and featuring wit Mr Ibu bin post about di death of di legendary phone.

She no too get plenti words, she just post “it is well. Rest well sir”. Dis really mean say na unexpected death of Mr Ibu hit her sake of her memory wit di deceased.

Peter Obi, Presidential candidate of di Labour Party (LP) bin also join di list of pipo wey send condolences to di late comic actor.

“Im death dey very sad. Im be one of di legendary comic actor wey carry laughter, show joy and spread happiness. Wen im be sick, we dey all pray for im quick recovery and dey hope say im go bounce back in good health.”

“Im death na a huge loss, not just to di entertainment industry, but to di nation. Doz artists wey lighten di mood of di nation also perform a great task to help us all to brighten di storms of our life.”

Skip Twitter post, 1

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 1

Candidate of di New Nigeria Peoples Party (NNPP) Rabiu Kwankwaso also send im condolence to di late Mr Ibu.

“Mr Ibu give us great memories for im life, putting smiles for di faces of many pipo wit im brilliant comic,” Kwankwaso write for im X page.

Skip Twitter post, 2

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 2

Mr Ibu die on Saturday afta ilness

Wia dis foto come from, RealMrIbu/Instagram

Ogbonge Nollywood actor John Okafor wey pipo sabi as Mr Ibu don die afta a battle with one illness.

Mr Ibu die on Saturday for one Lagos hospital wia im bin dey receive treatment for di illness wey give am long-time problem.

Di President of di Actors Guild of Nigeria, Emeka Rollas, confam di death of Mr Ibu on Saturday.

“I announce wit deep sense of grief say Mr Ibu no make am. Mr Ibu bin suffer cardiac arrest according to im manager for 24 years,” President Rollas tok for im Instagram page.

Mr Ibu bin battle serious health challenges for 2023 and im bin dey hopeful say im go fit survive am.

Mr Ibu na ogbonge nollywood actor

Wia dis foto come from, RealMrIbu/Instagram

Wetin we call dis foto,

Mr Ibu battle strange illness

Mr Ibu suffer cardiac arrest

Wia dis foto come from, Instagram/EmekaRollas

Mr Ibu battle with illness

For one video wey bin spread on top social media for October 2023, di actor dey beg im fans to pray for am.

Di actor say im don dey hospital for sometime sake of one a “strange and dangerous illness”.

E say doctors don recommend make dem cut im legs.

“As I dey speak to you, I still dey lie down for hospital; di medical director of dis hospital say di best solution be say, in case im new idea no work, di best idea na to cut off my leg”, e tok for di sick bed,

Mr Ibu further tok say make im fans tok to God as im no wan make dem cut im legs.

Mr Ibu adopted daughter also bin enta social media beg for support for her papa.

Jasmine Okafor, bin beg make individuals or organizations help her papa for treatment abroad.

“For di past two weeks, daddy don dey very down, so we take am to hospital.

We bin don dey do everytin humanly possible; as family, we bin tink say na sometin we fit do on our own for am to dey fine, but e no dey get any better.

E no dey get better. Some days, e go be like say e don dey get better, some days, e go be like say e dey get worse,” Jasmine bin tok.

“We dey for one of di best private medical facilities for Lagos, and dem wan refer us to anoda hospital sake of say e no get better here, she add.

No be di first time wey di actor sickness go enta public space be dis, for March 2022, Mr Ibu bin announce say e dey down wit food poisoning.

Born John Okafor, Mr Ibu na actor, stand-up comedian and MC from Enugu state, Southeast Nigeria.

E don act hundreds of Nollywood movies both for Nigeria and abroad.

Pipo sabi am for how im dey take keep im face wen e wan make pesin laff.

Im dey also dance and crack jokes.

For December 2023, di family of Nigerian Mr Ibu, bin clear di tori wey dey fly up and down on top mata of im health. Di tori be say di actor health don enta serious level plus doctors don amputate im second leg.

However, one member of im family Valentine Okafor for one post on di actor Instagram page bin set di record straight on Mr Ibu health say dem no amputate Mr Ibu second leg but na dat first leg wey dem cut doctors bin work on again.

“First we go like clear am say dem no amputate our daddy on both legs but only one. Di first amputation no completely correct im health predicament so di doctors get to go ahead to amputate di same leg further to make sure we no lose am”. Ms Okafor write for di post.

Di family also clear am say di sickness wey dey worry di actor no be diabetes but e get “constant clotting of blood for im leg (diseased blood vessels)” plus oda health challenges wey dey pose as risk to im life.





Source link

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here