Lagos-Calabar coastal highway: Between Peter Obi, Dave Umahi and Landmark beach

0
1


Minister of works drag Nigeria opposition leader

Wia dis foto come from, Dave Umahi/Peter Obi/Facebook

Minister of Works for Nigeria Sen. Dave Umahi and di Presidential candidate of Labour Party for di 2023 election, Peter Obi dey trend for social media sake of di Lagos-Calabar Coastal Highway.

Dave Umahi wey be former govnor of Ebonyi state call out Peter Obi for di comment im bin make about di Lagos-Calabar coastal higway project.

Di Minister of Works, Sen Dave Umahi sama allegation for Peter Obi, head say im dey inciting pipo for di southeast.

Obi na leader of opposition party for Nigeria, Labour Party – e contest di 2023 presidential election.

Na on Wednesday Umahi make di statement wen im dey tok during one event dem organise to compensate property owners wey di Lagos- Calabar coastal road project affect.

Umahi for di video wey dey circulate for social media tok say na Peter Obi bin demolish properties for Anambra state wen im be govnor to build roads.

Im add say Peter Obi bin also tok dat tin say im no go pay compensation, but na di same pesin dey tok about di loss of properties wey di Coastal Highway go cause.

Di minister of works explain say im no suppose chook mouth for di mata but local media draw im attention to am wen dem bring old video of Peter wen im bin wan bin road for Anambra state.

“Peter Obi wen im be govnor of Anambra state make statement say any infrastructure wey dey stand on di way of road construction must go and dem no go pay compensation. Na wetin im bin tok “

“But look at me sake of di human face of renewed hope agenda administration, we dey even pay pipo wey dey stay illegally for di coastline wey no even get valid infrastructure and document.

Wen you condemn pipo you bring judgement upon yoursef and na wetin im don do.

And I tink say im dey incite some of di Southeast pipo wey no dey well informed and im dey put dem for trouble and im no dey go fight for dem.

Wisdom na defence and wisdom dey give life to di pipo wey dey practice am, I want our pipo to get wisdom sake of say I dey involved” Umahi conclude. Concerning di demolishing of Landmark Beach, Oga Dave Umahi clear di air say, dem no carry any bad tin or bad plan for mind.

“No inhumanity dey metted on Landmark, make we bury di mata because I bin dey dia. Umahi add.

Wetin Peter Obi really tok

Yesterday Peter Obi bin tok about di Lagos- Calabar Coastal Highway. E para as goment to listen to wetin e describe as di cry of di pipo.

“Di outcry against dis project dey overwhelming due to di current situation for di kontri.

However, reports as of Monday indicate say demolition of businesses and residences for di designated right of way for di project don start from di Lagos end.”

Peter Obi for im tweet add say di demolition dey insensitive as e dey destroy pipo source of livelihood.

“Di sight of dis insensitive demolition dey heart-wrenching. Dem dey wipe Livelihoods away, and also dey waste lifetime investments, jobs dey disappear as bulldozers roar thru.

Di homes of di elderly dey overturned by di power of bulldozers.” Obi write

Skip Twitter post, 1

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 1

Meanwhile Nigerians don dey react on di trending issue for social media wey don dey cause gbasgbos.

Some Nigerians dey support di Coastal Highway project whuile odas no support am.

Skip Twitter post, 2

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 2

Skip Twitter post, 3

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 3

Di Lagos -Calabar Coastal Highway na one ogbonge project wey Nigeria goment don start.

Di 700km Lagos- Calabar Coastal Highway, go pass thru 9 States and e go get branches wey go lead to di Northern states too.

Di first phase of di project go cover 47.47 kilometers dual carriageway and goment say na concrete pavement dem go use construct am. Minister of Works Dave Umahi say di project go cost 15 trillion.

Im add say na 4 billion dem on spend every one kilometre.

Di 9 nine states di Coastal Highway go pass thru na Ogun, Ondo, Delta, Edo, Bayels, Rivers and Akwa Ibom.





Source link

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here