Enugu governorship election: Court uphold Peter Mbah election over Chijioke Edeoga of Labour Party [LP]

0
5


'Mbah no need NYSC certificate to contest election' - Enugu govnorship tribunal tell LP candidate Edeoga

Wia dis foto come from, MBAH/EDEOGAH/FACEBOOK

Di Governorship Election Petition Tribunal for Enugu State don uphold di election of Governor Peter Mbah of di Peoples Democratic Party (PDP).

Di candidate of Labour Party (LP) Chijioke Edeoga bin challenge Mbah for allegedly submitting forged National Youth Service Corps (NYSC) discharge certificate, among odas, but di court strike out di argument regarding di alleged forgery of di NYSC certificate.

Di tribunal tok say Edeoga fail to prove im allegation say di PDP candidate submit di forged certificate to Inec.

Dem also declare say NYSC certificate no be qualification to contest for govnorship election.

Di three-member panel wey Justice Kudirat Murayo lead bin give dia verdict on 21 September.

Di LP candidate bin also ask court to nullify di election of Mbah sake of alleged irregularities including over-voting and non-use of di Bimodal Voter Accreditation System during di election for di Nkanu East Local Government Area of di State.

“NYSC discharge certificate no be qualification for govnorship election,” di court tok.

“Assuming say dem forge di NYSC discharge certificate of di second respondent as di petitioner claim, shey NYSC certificate na qualification to contest for govnor for Nigeria according to di constitution? Di answer na no,” di tribunal tok.

Di tribunal strike out di ground as dem also add say some of di witness of di petitioners no dey accredited by Inec and diafor dia testimonies no fit dey reliable.

Dem say Edeoga fail to prove im allegation say di PDP candidate submit di forged certificate to Inec.

Di tribunal declare say Mbah dey qualified to contest di election even witout submitting any NYSC discharge certificate.

Dem tok say Senior Secondary School Certificate or im equivalent na minimum academic qualification for election for di office of di govnor in line wit Section 177 of di constitution.

Di tribunal also tok say di petitioner also fail to prove say Inec no use BVAS during di election for Nkanu East Local Government Area.

‘Na victory for democracy’

Govnor Peter Mbah describe di tribunal judgement as victory for di pipo of Enugu State and also for democracy.

“Na victory for Ndi Enugu. Na victory for democracy. Na victory for massive development for Ndi Enugu. Na victory for exponential growth, na victory for Enugu greatness,” di govnor tok.

Di govnor also tok say di tribunal judgement na victory for di ban on Monday sit-at-home wey dey shelle for Enugu State.

E also tok say na victory for di state goment determination to restore water for di homes of Enugu pipo in the next 68 days.

“We dey thnkful to God sake of say we know e no go dey possible witout God. We also want to put on record our deep appreciation to dia Lordships for painstakingly dissecting di petitions wey dem bring before dem and also coming out wit judgement wey resonate wit di pipo of Enugu State,” im tok.



Source link

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here