Electronic civil registration and vital statistics system wey Nigeria wan launch – What you need to know about am

0
4


National Population Commission Chairman Nasir Kwarra

Wia dis foto come from, National Population Commission

Wetin we call dis foto,

National Population Commission Chairman Nasir Kwarra, give pre-launch press briefing

Di Nigeria National Population Commission (NPC) dey launch di electronic Civil Registration and Vital Statistics System (e-CRVS) on Wednesday 8 November.

Dis launch wey be collabo between di commission and Unicef plus Barnksforte technologies limited, go also include one oda launching.

For di same occasion dem go also launch di National Geospatial Data Repository plus inauguration of di National Coordination Committee on CRVS.

For statement wey dem release for dia website, di commission say di purpose of di online register na to help make sure say di civil register capture, gada, process and circulate plus give informate sharp sharp on di different different important statistics for di kontri.

Di plan na to make all dis possible inside ten years as part of Nigeria goment plan to achieve di sustainable development goals.

So wetin be e-CRVS and how e go take benefit Nigerians?

Wetin be Civil Registration

To understand e-CRVS, e important to understand wetin Civil Registration mean first.

Civil Registration according to United Nations na di โ€œcontinuous, permanent, compulsory and universal recordingโ€ of pipo by registering all di important tins for di life of di population.

Dis registration according to UN must to occur according to โ€œdi legal requirements of each kontri.โ€

Di important tins wey dey occur for pesin life, wey affect im life as citizen, like birth, death, stillborn, marriage, divorce, foundings, naturalisation, plus odas like dat.

Dis informate or dat dey necessary becos e get to do wit vital or important tins for pesin life from wen im enta world till wen e leave am and everi wey go happun to am between life and death.

For Nigeria, di law make am compulsory to record all dis kain important events.

Screenshot of di portal for e-CRVS

Wia dis foto come from, Screenshot

Wetin we call dis foto,

Di portal for e-CRVS

Benefits of e-CRVS

According to di National Population Commission, dis e-CRVS get some correct benefits wey dem divide into three category; statistical, medical and administrate.

Statistical benefits

Di important statistics wey di e-CRVS go provide go give additional informate on di trend and pattern of fertility and death for di whole kontri and for small areas for di kontri, wey no get any connection wit national census.

Di complete registration of pikin wey dem born go help give imformate about di number of boys versus di number of girls wey dem born wey dem call sex ration.

Dis sex ration go be ogbonge informate wey goment gofit use take plan ahead, as per di kain population wey dem go expect for future.

Data from civil registration go give information on di seasons wey pipo dey born pikin pass plus season wen pipo dey die pass. Dis information dem say dey important for planning di services wey dey related to dem.

Dis system go help check census enumeration, particularly among new born pikin, small pikin and young age groups. Usually e dey common to under count dis group of pipo.

Medical benefits

Data on deaths and wetin cause dem dey necessary for di planning of health services for some specific areas and for di whole kontri.

For example, statistics on wetin dey cause death dey useful for predicting di future direction of death of different age groups.

Di analysis of di patterns, causes and spread of disease wey dey cause death, dey usually dey based on records of vital statistics wey di system go gada.

Administrative benefits

Di record of birth registration dey provide necessary legal and documentary evidence to confam pesin age, parents, wia dem born am, and nationality or citizenship.

You go fit use birth certificates to determine weda pesin dey qualify to register for and get admission for school, get passport, employment, age group competitions, participate for sports, dey entitle to health care, voting for elections, plus oda tins.

Pipo go fit enjoy oda social benefits, like family allowances, insurance claims, child care allowances, tax relief, and oda correct tins wey go usually need birth certificate.

Records of death and death certificates go provide legal evidence wey necessary for claiming property, insurance benefits wey dey related to pipo wey don die, give right to surviving husband or wife to remarry, and for family allowances.

Birth certificate dey help check di palava of child trafficking, early marriage for small girls, child labour, child soldiers, police harassment and unlawful detention.



Source link

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here