Champions League round of 16 draw: Arsenal, Milan, PSG, Real Madrid, Manchester City go sabi dia opponents

0
2


Champions League Round of 16

Wia dis foto come from, Getty Images

Di round of 16 of Uefa Champions League go hold next year 2024 afta di end of di group stage last week.

All di teams wey qualify for di next round go sabi dia opponents on Monday – Uefa go do di Champions League Round of 16 draws.

Di defending champions na Manchester City and as di competition dey go so far, na dem still be favourites to win di trophy despite say dem dey struggle for di Premier League.

Di second English club wey qualify for di next round na Arsenal. Dem finish top of dia group Ahead of PSV, Lens and Sevilla.

Despite say dem neva play for di Champions League for a long time, dem seed gi Gunners for di draw.

Manchester City and di London club get chance to reach quarter finals since dem go avoid di big teams like Real Madrid, Bayern Munich and Barcelona for di round of 16.

Oda teams wey pipo dey eye na PSV, Napoli, Inter Milan, Lazio, Paris Saint Germain, Porto and odas.

Champions League Round of 16

Di draw go happun by 11.00 GMT dat na 12pm (WAT) on Monday.

You fit monitor am for Uefa website.

Di first legs of di next round go hold for 13-14 and 20-21 February 2024, while di second legs go hold for 5-6 and 12-13 March 2024.



Source link

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here