Atiku press conference: ‘Why I dey pursue Tinubu certificate for Chicago state university’

0
2


‘Why I dey pursue Tinubu certificate for Chicago state university’

Wia dis foto come from, Tinubu/Atiku/Facebook

“Di certificate wey Nigeria President Bola Tinubu submit give di kontri electoral body na fake.”

Dis na wetin one lawyer to di Presidential candidate of di Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar for di 2023 general elections allege.

Di lawyer, Kalu Kalu for one press conference wey oga Atiku Abubakar organise claim say President Tinubu submit forge di degree certificate e submit give di Independent National Electoral Commission (Inec).

Although di presidency and im supporters don deny di allegations of forgery.

Kalu explain wetin dey di document

Kalu explain say di documents show say “One, dat Bola Ahmed Tinubu forge di certificate e present give Inec.

“Two, di name wey dey di qualifying certificate from South West College to Chicago State University na woman name wey show say no be Bola Ahmed Tinubu get di document.

“Three, di Chicago State University admission form claim say Bola Ahmed Tinubu attend Government College Lagos and graduate for 1970 wen indeed dem establish di school for 1974.

“Di same document show say di owner of dat document na black American and (in) di document wey Bola Ahmed Tinubu submit to Inec, e deny say im no get dual citizenship, wey mean say no be him get di document.

Den, di same document, oral deposition, tok say di A in Bola A Tinubu na Ahmed but di NYSC certificate wey Bola Ahmed Tinubu submit give Inec get Adekunle. I no know wia Adekunle emerge from.”

Na Gani Fawehinmi ginger me to go afta Tinubu certificate – Atiku

Anticipation high afta tori spread say former Nigeria vice president wey also be di candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) Atiku Abubakar for di 25 February election, go address world press conference on Thursday, 5 October.

Many Nigerians bin dey expect say e go address di outcome of di suit e file against President Bola Tinubu ova im academic record for di Chicago State University.

Atiku bin file request say make Chicago State University provide president Bola Tinubu records to show say e attend di university.

Wen tori pipo ask am to react to di documents wey CSU release afta di suit e file, na one of im lawyers e allow to react to di mata.

However, di PDP presidential candidate for im address call on oda presidential candidates to join am for im legal battle against President Bola Tinubu, particularly on top di certificate forgery allegation against di president.

E specifically call on Labour Party presidential candidate, Peter Obi, wey also dey Supreme Court on top di election mata, and presidential candidate of di New Nigeria People Party, Rabiu Kwankwaso.

“Dis mission no be for or about Atiku Abubakar. Na mission for di enthronement of truth, morality and accountability for our public affairs, therefore, I dey call on well-meaning Nigerians, leaders of though, our religious leaders, traditional, community, political leaders, and in particular, govnor Peter Obi of di Labour Party and govnor Rabiu Kwankwaso of di NNPP and, di leader of every political party for Nigeria, make una join me for dis campaign to enshrine to enshrine probity, morality plus uprightness for our kontri and goment…”

E add say na one late human right activist, Chief Gani Fawehinmi ginger am to take dis path.

Atiku declare say im no go back down until Supreme Court give dia judgement on who be di authentic winner of di 25 February election.

Tinubu university certificate no be forgery – aide

One official wey dey work for Nigeria President Bola Tinubu don deny accusations wey claim say oga Tinubu present forged university diploma give di kontri electoral body.

During one hearing on Tuesday, one official from di Chicago State University (CSU) bin tok say oga Tinubu graduate from di university for 1979.

However, di official say di university no fit verify di authenticity of di diploma wey oga Tinubu present give Nigeria Independent National Electoral Commission (Inec) as di university no dey keep copies of student diplomas.

E also testify say di signature, logo, and seal for di certificate wey di president submit to Inec different from those wey dey di oda certificates wey CSU issue for Mr Tinubu graduation year.

Temitope Ajayi, Mr Tinubu special assistant on media and publicity on Wednesday tok say “di claim say President Tinubu submit fake certificate give Inec no make sense” as Mr Tinubu don already get di university certificate”.

E also tok say di replacement certificate wey ogaTinubu presented to Inec dey valid as di CSU official bin confam say “na vendors dey do replacements for lost certificates no be di university”.

Brief background of di mata

Atiku Abubakar, wey run against oga Tinubu for Nigeria February presidential elections bin petition one US court say make e order CSU make dem release oga Tinubu academic records.

Di PDP candidate bin request for di documents to use am support im argument for Nigerian courts, say President Tinubu forge di certificate e claim to obtain from CSU for 1979, wey e submit give Nigeria electoral body, di Independent National Electoral Commission (Inec), for di 2023 presidential election.

Di accuse of forgery na one of di allegations di Nigeria presidential election court dismiss for di suit Atiku file to challenge di election of Tinubu.



Source link

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here