Aisha Bello dead: Profile of NTA former news presenter wey die afta a brief illness

0
2


Aisha Bello dey read news

Wia dis foto come from, Other

Nigeria President Bola Tinubu don react to di tori of di passing of ogbonge broadcaster, Aisha Bello Mustapha.

According to reports, di presenter wey be popular face on Nigerian televisions in di 90s and early 2000s die afta one brief sickness for Abuja, di kontri capital.

Nigeria President Bola Tinubu for one statement wey tok-tok pesin Ajuri Ngelale sign tok sorry and pay solemn respect to di family, friends and colleagues of di late broadcaster. Di statement describe her as one of di great icons of di Nigerian broadcast media.

“She mentor many young women wey go into broadcasting, just by watching and listening to her eloquence, passion, and integrity on di screen, for di newsroom, and off di screen.

“Her legacy for broadcast journalism live on for di rich news archives she leave behind and her contributions to di development of broadcasting in Nigeria. She bring news to life and she go continue to be a beacon to inspire generations for di beautiful art of broadcasting,” di presidency tok.

Meanwhile, Zainab Sabo wey be friend of Aisha family confam di death and add say her funeral prayer go take place for Abuja Central Mosque by 1:00pm on Monday.

“Na true say Mama (Aisha) don die and her funeral prayer na 1:00pm we go really miss her and we pray for God to bless her soul” Zainab tell BBC Pidgin.

Profile of Aisha Bello Mustapha

After 35 years work with di Nigeria Television Authority (NTA), Aisha retire for May 2022, wey conclude her remarkable career for di broadcasting industry.

Aisha dey versatile and her skill set include journalism, television production, broadcasting, editing, and her last role na as di General Manager of NTA Parliament before retiring.

Di professional manner and her unique style solidify her as one of NTA most popular faces and voices, leaving a big mark for di Nigerian broadcast industry.

Aisha legacy for Nigerian media dey big. She bin start her journey at NTA, rising to di role of assistant director of news and later becoming di general manager of NTA Parliament and also featuring as one of di popular broadcasters on NTA Network News during di ’90s and early 2000s.

In terms of education, she bin earn a Bachelor’s degree for Mass Communication/Media Studies from Ahmadu Bello University wey dey Zaria for Kaduna state.



Source link

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here