Afcon 2023 awards: Troos-Ekong, Ivory Coast coach Emerse Faé, Simon Adingra, Ronwen Williams and full list of CAF Afcon 2023 awards

0
4


Afcon 2023

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto,

Super Eagles captain, Troost-Ekong pose wit im award wit Caf President, Patrice Motsepe

Di 2023 Africa Cup of Nations don come and go, but pipo wey like football still dey tok about di tournament.

Di biggest international football competition wey happun for Ivory Coast from 13 January to 11 February 2024.

Hosts Ivory Coast beat Nigeria 2-1 to win the trophy for di third time at di expense of Nigeria.

However, Nigeria still get somtin to use hold body, as captain William Troost-Ekong follow for di players wey get special recognition during di awards.

William Troost-Ekong wey win di Man of di Compeition award, bin score three goals for di tournment.

Even though Ahmed Musa na di captain of di team, Ekong captain di Super Eagles for pitch to a surpise second place finish.

Oda pipo wey collect award

Afcon 2023

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto,

Emilio Nsue pose wit Ronwen Williams wit dia Caf awards

Di Confederation of African Football also give awards to oda players wey do well for di tournament.

South Africa goalkeeper, Ronwen Williams beat Stanley Nwabali of Nigeria to win di Best Goalkeeper of di tournament.

Afcon 2023

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto,

Ronwen Williams pose wit Fifa President, Gianni Infantino

Afcon 2023

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto,

Golden Boot winner Emilio Nsue pose with President of Caf Patrice Motsepe

Equatorial Guinea front man Emilio Nsue win di Golden Boot award and best player of di tournament.

Di Equatorial Guinea captain score five goals in four matches including hat trick against Ivory Coast.

Gelson Dala of Angola win di Silver Boot ward, e score four goals.

Anoda Angola player Mostafa Mohamed win di Bronze Boot, e score four goals too.

Afcon 2023

Wia dis foto come from, Cafonline

Wetin we call dis foto,

Emerse Fae

For oda individual awards, Ivory Coast coach Emerse Faé win di Best Coach of di tournament.

E start to lead Ivory Coast afta dia worse performance against Equatorial Guinea.

Ivory Coast concede 4 goals from Equatorial Guinea for dia last Group A match wey make dia former coach Jean-Louis Gasset resign. Na afta e resign Fae take over.

Afcon 2023

Wia dis foto come from, Cafonline

Wetin we call dis foto,

Simon Adingra

Cote d’Ivoire still win di Best Young Player of di tournament and na Simon Adingra win am.

Adingra dey very skillful, e really show im talent, especially for di final. E disturb Nigeria defender Ola Aina well well, wey lead to di second and winning goal.

Meanwhile, Bafana Bafana of South Africa win di Fair Play Team award.

How Nigerians react

From Sunday night na im social media begin buzz and press statements begin fly upandan.

As e dey sweet di Ivorians, e pain Nigeria well well say dem lose dis final. Last last Nigerians console demsefs say dem finish second.

One of di pipo wey react na di President of Nigeria, Bola Tinubu.

For inside statement, di Nigerian president hail di team as im tok say dem show “great resilience and talent of di nigerian pipo”.

“Make dis passing event not dispirit us, but make e bring us togeda to work harder. We be great nation bound as one by di green-white-green banner of resilience, joy, hope, duty, and untiring love.

To di cherished Nigerian youths wey dey express dia gifts for communities, drawing lines inside sand as dem play football for dia humble rectangles of play, you fit be our heroes tomorrow, no relent in your pursuit. My administration dey hia to make dreams come true,”

E add say Super Eagles put in dia best efforts, but at di end, Cote d’Ivoire emerged victorious and win di cup.

“I congratulate our national team, and indeed every Nigerian, for our great display of talents and football skills wey carry us go far in di tournament.”

Super Eagles goalkeeper Stanley Nwabali tell Nigerians sorry sake of di loss.The Di Nigeria goalkeeper wey dey play for South Africa Club Chippa United describe di match as “frustrating end,”.

Im add say di team go take full responsibility for di loss. Im also tell Nigerians ‘thank you for all di suport during di tournament.

Stanley Nwabali bin dey in di race for di Best Goalkeeper award but im lose am to Ronwen Williams of South Africa.



Source link

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here