Wofai Fada wed Taiwo Cole: Actress marry into Cole family of Vcitoria Island

0
3
Wofai Fada wed Taiwo Cole: Actress marry into Cole family of Vcitoria Island


Nigerian actress Wofaifada and her boo Taiwo Cole

Wia dis foto come from, Wofaifada/Instagram

Many Nigerian celebrities don turn out to hail one of dia veri own Wofai Ewa wey many pipo sabi as Wofaifada on di announcement of her wedding.

Di Nigerian actress and comedienne bin announce her marriage to Taiwo Cole on her Instagram account.

For her Instagram account, Wofaifada share pictures and videos of her and Taiwo Cole wit captions wey mean say dem don marry.

For one particular foto, she flaunt her wedding ring wit her bobo wit di hashtag #TWO24.

Ogbonge celebrities like Funke Akindele, Ayo Makun, Toke Makinwa, Kemi Adetiba, Shaffy Bello, Chioma Akpotha, Ric Hassani among plenty odas don congratulate di latest bride and groom.

However, social media don scata following di announcement of di wedding afta one alleged statement from di groom family wey BBC News Pidgin neva fit confam surface online.

For di alleged statement from di prominent Cole family of Victoria Island for Lagos State, dem allegedly distance diasef from di union between dia son and di actress.

Di alleged statement, wey one Kunle Cole sign on behalf of di family and wey don go viral and don become hot topic for social media, say di family no dey aware of di marriage plans and dem no grant consent or support to di marriage.

“Dis na to notify all acquaintances, family and friends say di Cole family of Victoria Island, Lagos, no dey aware of any marriage ceremony of our son, Taiwo Olakitan Cole; we no grant permission or support in dis regard.

“As such, pesin(s) wey dey parade diasef as new members of di Cole heritage by virtue of dis purported event, no dey known nor accepted by di family. Disregard all publications and documents wey dey circulated about dis mata,” di statement tok.

However, shortly afta di alleged statement from di family of di groom, di bride post one short video wia she and her bob wear traditional attire and she say “Let love lead.”

For anoda video, she say “I find my happily eva afta, and I say yes!! Chai!! Love dey sweet o.

Skip Instagram post, 1

Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 1

Her husband Taiwo Cole comment for di post say: “I find a good wife and no going back.”

Screenshot

Wia dis foto come from, Wofaifada/Instagram

Skip Instagram post, 2

Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 2

Who be Wofaifada?

Wofai Fada

Wia dis foto come from, Wofaifada/Instagram

Wofaifada na woman of many feathers.

Apart from say she be popular Nigerian actress, Wofaifada na comedian, television presenter, entrepreneur and internet sensation wey dey popular for her skits.

She bin feature for one popular TV Sitcom, flatmates.

Beyond her work for media, Wofaifada also na successful entrepreneur for di food and drink industry. She also write cookbook.

She come from Cross-River State, south-south Nigeria.





Source link

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here